Earthquake in Turkey and Syria: Wetin to do in case of an earthquake

Wia dis foto come from, Getty Images
Natural disasters fit be di last tin for your mind before you travel for holiday or migrate.
But to know some few simple tins fit make di difference between life and death in case of emergency.
Afta di tragic earthquakes wey happun for Turkey and Syria, on 6, February 2023 and kill thousands of pipo, we don put togeda a guide on wetin to know wen you dey travel go earthquake-prone locations.
Before you leave: Always register wit your kontri embassy for di destination wey you dey travel go.
To register you go either call di embassy directly or some kontries go allow you to input your travel plans online.
Wen you arrive: Carry local emergency and embassy phone numbers for your wallet, or save dia number for your phone.
Wen you check into your hotel room, identify safe places to hide in case earthquake happun – under a heavy desk or table; against an inside wall; stay away from windows, mirrors or heavy furniture wey fit fall over – avoid location near di stairwells.
Just a note say contrary to popular belief, doorways no generally dey stronger dan any oda part of a building and no suppose be your go-to place for shelter in di event say earthquake happun.
During earthquake: If you dey your hotel room, go immediately to one of your identified safe places, lie down and hold on.
For rooms without strong furniture, stay for one corner of di building and cover your face and head wit your hands.
If di earthquake happun while you dey for bed and di room no get overhead light fixtures, stay for bed and protect your head wit pillow.
If you dey outdoors,